Kind of english text...
Di Vatican don approve new guidelines wey allow gay men to become priests as long as dem stay away from sex.
Di announcement na unexpected adjustment to practice in di Catholic Church, from di bishop go alow gay men to enta seminaries.
Although di Vatican in di past bin neva clearly ban gay men make dem no enter priesthood.
One 2016 instruction bin no allow men wey get "deep-seated homosexual tendencies".
Na di Catholic Church for Italy bin draw up dis new guidelines in November but Vatican clergy office just confam am.
Di 68-page guidelines no follow for wetin di Pope bin tok in May, 2024 wen e bin say e get "already too much faggotry" among trainee priests wey dey Catholic seminaries.
E bin say , "frociaggine", for Italian language wey many see as offensive.
Although no be for public e bin tok am, na for one meeting wit bishops e bin shelle.
Di Pope bin tok say e dey against gay seminarians wey dey lead "double life".
E later tok sorry, say e bin no get mind to use homophobic language for one apology wey e bin send out.
.
.
Kind of english text...
>Di Vatican don approve new guidelines wey allow gay men to become priests as long as dem stay away from sex.
>Di announcement na unexpected adjustment to practice in di Catholic Church, from di bishop go alow gay men to enta seminaries.
>Although di Vatican in di past bin neva clearly ban gay men make dem no enter priesthood.
>One 2016 instruction bin no allow men wey get "deep-seated homosexual tendencies".
>Na di Catholic Church for Italy bin draw up dis new guidelines in November but Vatican clergy office just confam am.
>Di 68-page guidelines no follow for wetin di Pope bin tok in May, 2024 wen e bin say e get "already too much faggotry" among trainee priests wey dey Catholic seminaries.
>E bin say , "frociaggine", for Italian language wey many see as offensive.
>Although no be for public e bin tok am, na for one meeting wit bishops e bin shelle.
>Di Pope bin tok say e dey against gay seminarians wey dey lead "double life".
>E later tok sorry, say e bin no get mind to use homophobic language for one apology wey e bin send out.
.
.
[Source](https://www.bbc.com/pidgin/articles/cvgpl6ze6d8o)
(post is archived)